FG Show 40 Electric Buses to Push Clean Energy Movement

Government say new electric buses go reduce transport cost and promote clean-energy future

Must read

Federal Government don yan say e go continue to support clean-energy projects wey go reduce pollution and make transport cheaper for Nigerians, as dem commission 40 electric buses under the Presidential Initiative on Compressed Natural Gas (PiCNG) for Abuja on Thursday.

Minister of State for Gas, Ekperikpe Ekpo, wey send him aide Abel Igheghe come represent am, talk say the rollout show Nigeria serious about moving from old fuel to cleaner energy like CNG, LPG, LNG and electric motors.

According to am, “No be just to showcase product. Na strong message say Nigeria dey enter new era of clean mobility. Electric vehicles go open new jobs, new industries and new opportunities for our people.”

Ekpo still talk say the Ministry of Petroleum Resources dey work to promote gas as transition fuel and ensure say better technology reach Nigerians so transport go cheap for ordinary people.

E assure Nigerians say the electric buses no be for ceremony; dem go start to run this week and spread reach many states before Christmas.

PiCNG Chairman, Ismael Ahmed

PiCNG Chairman, Ismael Ahmed, talk say the 40 electric buses signal new beginning for cheap and clean transport for the country.

“This na clean energy, affordable energy and available energy,” he talk. “The important thing na make transport price come down for the ordinary Nigerian.”

Ahmed yan say PiCNG go power charging stations with CNG and from January 2026, dem go open five LCNG stations for Kano before moving go Kaduna, Gombe, Maiduguri and Katsina.

He add say PiCNG dey work to make transport cheap, stable and safe for everybody.

Nigeria clean-mobility push dey inside the Energy Transition Plan wey target net-zero emissions by 2060. The commissioning of the 40 electric buses na the first major rollout under the EV roadmap and show say Nigeria wan lead for Africa clean transport market.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article