Former Vice President, Atiku Abubakar, don raise heavy alarm say President Bola Tinubu govment dey drag Nigeria enter one chance of authoritarian rule.
For statement wey Atiku drop Friday, im point recent wahala for Kaduna, Katsina and oda states as proof say democracy don dey under heavy attack.
E mention how police invite Nasir El-Rufai, former Kaduna governor, how dem disrupt meeting of Katsina Elders Forum, and even how dem attack convoy of Abubakar Malami, former Attorney General. Atiku yarn say all dis one no be mistake – e be like coordinated plan to silence opposition and elders.
“Dissent na life of democracy. Any govment wey dey intimidate people or use security men as weapon against opposition no fit claim say e dey protect democracy,” Atiku warn.
E come add say if Nigerians no stand gidigba now, di country go soon waka back enter dark era of fear, silence and impunity.
Atiku remind Tinubu say power na temporary, but history go judge anybody wey use am against di people instead of to serve dem.
“Nigeria belong to all of us. Liberty, justice and rule of law no suppose dey sacrificed for partisan desperation,” Atiku tok.
E beg Nigerians make dem open eye, talk true, and no leave fight to defend democracy only for opposition hand.


