TheStreetNewspaper don gather say former President Goodluck Jonathan dey reason to return for 2027 presidential race. Even though before dem talk say him no dey interested, new signal dey show say oga Jonathan fit throway cap for ring.
Some PDP stakeholders don dey move underground to package him candidacy. Jonathan sef don dey meet big men like General Ibrahim Babangida. Him cousin Robert Azibaola and media aide Ikechukwu Eze dey dismiss any talk say oga Jonathan no go contest.
But wahala dey. PDP zoning formula fit block Jonathan chance, plus South-South and South-East wey used to be him stronghold no dey sure again. Analysts dey ask: Jonathan go return as politician or remain elder statesman?


