Qatar Ministry of Interior don bring out new visa policy wey go affect Nigerians wey wan travel enter the country. Dem say di matter dey follow many cases of people wey overstay their visa for Qatar.
According to wetin TheStreetNewspaper gather, anybody wey wan apply for tourist or transit visa now gatz book return ticket plus hotel reservation before dem go fit process am.
But di biggest change be say: men no fit apply again unless dem dey travel with their family. Na only women and families dem go dey accept.
Another condition wey dey inside di new rule na say only 5-star hotel booking go qualify person for visa approval.
Dis new regulation don start immediately and e go affect even people wey don already get pending visa application.


