Abuja — Federal Government don finally publish Nigeria new tax reform laws for official gazette, wey dem describe as di biggest shake-up for di country tax system in many years.
According to statement wey Kamorudeen Yusuf, Special Duties PA to President Tinubu sign on Wednesday, di President don sign di reforms into law on June 26, 2025.
Di new laws include:
Nigeria Tax Act (NTA), 2025
Nigeria Tax Administration Act (NTAA), 2025
Nigeria Revenue Service (NRSEA), 2025
Joint Revenue Board (JRBEA), 2025
For di new arrangement, small businesses wey dey turn over less than ₦100m yearly and get assets below ₦250m no go pay corporate tax again.
For big companies, corporate tax fit reduce from 30% to 25%, if President gree. Dem also put top-up tax threshold for ₦50bn (local firms) and €750m (multinationals).
Other sweeteners include 5% annual tax credit for projects wey fall inside priority sector. Companies wey dey transact for foreign currency fit now pay tax in naira at official exchange rate.
Implementation go start in stages:
NTA & NTAA → January 1, 2026
NRSEA & JRBEA → June 26, 2025
FG talk say di reforms go simplify tax, support small businesses, attract investors, and reduce Nigeria wahala of depending on oil.


