APC Don Grab Two-Third Majority for House of Reps

Five PDP reps and one LP member dump their parties for APC, give Tinubu strong backing in National Assembly

Must read

The ruling All Progressives Congress (APC) don finally get two-third majority for House of Representatives after six opposition lawmakers waka go join dem.

For Thursday plenary, five PDP members from Enugu and one Labour Party member from Plateau State dump their parties go join APC.

The lawmakers wey defect include Daniel Asama Ado (Plateau), Chidi Mark Obetta (Enugu), Phillips Anayo Owuegbu (Enugu), Nnaji Nnolim (Enugu), Denis Agbo (Enugu), and Matthew Nwogu (Imo).

Wit dis new move, APC number for House don rise reach 242 members while PDP remain wit 74.

Dem write letters wey Speaker Abbas Tajudeen read for plenary, say na party wahala and leadership gbege make dem comot.

Dis new development don make APC stronger for National Assembly as dem fit now pass bills and support President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda without much wahala.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article