Former Nigeria President, Goodluck Jonathan, don talk say wetin happen for Guinea-Bissau no be real coup at all. According to am, di kain drama wey play out on Wednesday no resemble wetin military coup dey look like.
Jonathan bin dey Guinea-Bissau as part of AU, ECOWAS and West African Elders Forum election observer team, when di military announce say dem don take over power and later swear in General Horta Inta-A Na Man as leader for one year.
But Jonathan say di whole matter get K-leg. Him yarn say na President Umaro Sissoco Embaló — the same person wey dem claim say military arrest — first announce di coup to di world. And even as dem talk say him don dey “arrested,” di man still dey use him phone dey talk to international media.
Jonathan say no coup dey happen like that.
He add say as person wey don live almost 70 years and don witness coups for Nigeria and Africa, he know say once military overthrow government, di sitting president no dey get chance to dey grant press interviews or dey announce him own arrest.
Jonathan believe say Embaló, wey be former senior military man, no fit just dey pushed aside like that. He suggest say something else dey under di matter.
Di ex-president say di situation dey pain am well-well, even pass di day him call Buhari to congratulate am after him lose di 2015 election.
Jonathan end by saying say di kind political drama wey happen for Guinea-Bissau dey worry person wey believe for true democracy.


