PENGASSAN, Dangote Wahala Don Big Over Salary Suspension

Engineers wey reject redeployment to other Dangote projects accuse company of victimisation.

Must read

Wahala between PENGASSAN and Dangote Petroleum Refinery don worsen as the refinery stop to pay monthly salary to the engineers wey dem sack for September during union wahala.

Information wey leak show say Dangote stop the salary because many of the engineers refuse redeployment go places like Zamfara, Borno, Benue, Sokoto, Kebbi, Niger, Ebonyi and plenty other states.

Some of the engineers yarn say Dangote send dem go coal mine for Benue, concrete road sites for Borno and Ebonyi, and rice plants for Kebbi, Niger, Sokoto and Zamfara.
Few accept the posting, but majority reject am because PENGASSAN tell dem make dem wait for dialogue.

Report also show say Dangote first warn dem for October by cutting their salary small before stopping November payment completely.

One senior Dangote official confirm say:
“Why we go dey pay people wey no gree take the work we give dem? We offer new positions, dem say no.”

But the affected engineers call am victimisation, say the new work locations no get address, no appear for Google map, and some be security hot zones.

One of the letters titled “Offer of Trainee Engagement” ask them to resume for Dangote coal project for Benue with two years of training.
The workers say the letter no clear and na trap to terminate them.

PENGASSAN Still Dey Negotiate

PENGASSAN President Festus Osifo talk last week say:
“Even after the national strike, we still dey engage Dangote. Issues never finish but we dey push make dialogue settle everything. We no want another industrial action unless e become compulsory.”

Background

For September, PENGASSAN shut down oil and gas operations nationwide after claiming Dangote sack 800 workersbecause dem join union.
Dangote deny am, say na small workers wey dey “sabotage” dem remove.

The shutdown affect oil production and even reduce power supply before FG intervene order Dangote make dem redeploy the staff, no be sack dem.

Negotiations still dey drag as workers insist on fair treatment.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article