Nigeria Don Enter Top Countries Wey Dey Cause Cyber-Attacks — Union Bank Oga Tok

Union Bank raise alarm say Nigeria lose over N100bn to cyber-attacks for 2023 as banking sector risk level rise.

Must read

LAGOS — Union Bank don raise alarm say Nigeria don join the top countries for world wey cyber-attacks dey come from, after heavy loss wey reach over N100 billion happen for 2023 alone.

Managing Director of Union Bank, Madam Yetunde Oni

Di Managing Director of Union Bank, Madam Yetunde Oni, through her representative Madam Olufunmilola Aluko, yarn dis one for di 63rd Quarterly General Meeting of Chief Audit Executives of Banks (ACAEBIN) wey dem hold for Lagos.

She tok say di cybercrime wahala no be small again as di risk level don change well-well.

“Cybersecurity no be IT issue again o — na whole-organisation matter. Internal audit suppose dey lead to check, question and make our controls strong,” she talk.

Oni add say Nigeria’s financial sector dey face many disruptions:
– economic pressure wey dey shake balance sheet,
– exchange rate wahala,
– fast digital growth wey bring new risks,
– more sophisticated cyber-attacks,
– and strong regulatory demands.

Union Bank Chief Audit Executive, Mr. Isiaka Arowolo, come talk say hosting ACAEBIN show say Union Bank still stand gidigba for transparency and strong governance.

ACAEBIN chairperson Madam Aina Amah also remark say di world dey move fast and banks must get sharp mind and courage to meet today’s risks.

Madam Aina Amah

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article