Ex-Anambra Governor Chris Ngige Don Get Arrest for Abuja

Chris Ngige dey EFCC custody after operatives storm im Abuja house.

Must read

Former Anambra State Governor and immediate past Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige, don land for EFCC custody after security operatives storm im house for Abuja on Wednesday night.

The arrest happen for im residence wey dey Justice Mohammed Bello Street, but confusion first bust out because no security agency claim the operation early. Some people even tink say na kidnap.

EFCC Officials

But later, multiple sources confirm say na EFCC operatives carry out the operation. One person wey sabi wetin happen yarn say Ngige even face “humiliation during the arrest”, add say, “na EFCC work, no be kidnap.”

Ngige former media aide, Fred Chukwuelobe, later confirm say the ex-governor dey EFCC hand. For im short statement, he talk: “Former Governor of Anambra State and immediate past Minister of Labour and Employment, Dr. Chris Ngige, is with the EFCC. More details later.”

Up till when we file this report, EFCC never talk officially, so nobody still know why dem arrest am.

This matter dey happen few days after gunmen attack Ngige convoy for Anambra State. One police officer collect bullet and others wound, but Ngige no dey inside the motor at the time.

No be today Ngige life don dey full drama. For 2003 when he be governor, political actors abduct am for one incident wey shake the whole country.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article