Larry Ellison Don Pass Elon Musk as World Richest Man After Oracle Shares Blow Up
Oracle co-founder, Larry Ellison, don use one sharp market move take waka pass Elon Musk become World Richest Man – even if na just for small time.
Ellison pocket swell with $89 billion in one day after Oracle announce correct quarterly results wey beat wetin analysts expect, plus better forecast for more growth. Na di biggest one-day money jump ever recorded.
Di fresh gain push Ellison net worth reach $383.2 billion, according to Bloomberg Billionaires Index. Na dis sharp rise make am carry first position pass Musk, before Tesla boss later collect back di crown with just $1 billion difference.
Oracle shares don dey shine this year – dem rise 45% before Tuesday close, and on Wednesday dem surge 36% again. Na di largest single-day gain since 1992, and e even add $97 million join di net worth of Oracle CEO, Safra Catz.
Meanwhile, Tesla no too dey smile – shares don drop 14% this year, although board dey cook one massive pay package for Musk wey fit turn am di world first trillionaire if e hit all di targets.
Ellison, wey be 81 years old, co-found Oracle since 1977 and now dey serve as chairman and chief technology officer. Most of im wealth dey tied inside Oracle stock, wey don benefit heavily from cloud computing demand and AI deals with OpenAI and Nvidia.
Musk on di other hand first collect “World Richest Man” crown back in 2021, but since then e don dey trade places with Jeff Bezos of Amazon and Bernard Arnault of LVMH, before e regain am last year and hold am for over 300 days.
Dis Ellison vs Musk battle show how billionaires’ ranking fit shift overnight, as stock market dey control who go dey top.


