DSS don carry Omoyele Sowore, activist and AAC presidential candidate, go Federal High Court Abuja. Dem accuse am of call President Tinubu “criminal” for X and Facebook.
Court paper show say DSS file 5-count charge against Sowore, Meta (Facebook) and X Corp. Evidence na screenshot of di posts and DSS letters wey dem send.
But Sowore say he no go delete di post, na him constitutional right to talk as citizen. “You no fit teach me how to criticise President,” he blast DSS.
X sef reply say dem no go delete am. Meta never talk anything.


