Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don hail President Bola Ahmed Tinubu for lifting di emergency rule wey bin dey on top Rivers State.
Wike yarn say di President action na correct step wey show him commitment to peace, democracy and progress for di kontri.
For statement wey him Senior Special Assistant on Public Communications and Social Media, Lere Olayinka release on Wednesday, Wike talk say Tinubu intervention don restore hope and confidence for di people of Rivers.
“President Tinubu don once again show say him dey proactive. Di decision wey he take don save Rivers State from wahala and restore di faith of di people for him leadership,” Wike talk.
Di former Rivers State governor come hail di pipo of di state for di way dem stand gidigba behind Tinubu during di crisis. He beg all political actors make dem drop wahala and work together for di betterment of di state.
Wike also warn di “fifth columnists” wey dey always try chop from crisis make dem waka clear.
“From Rivers State going forward, na only beta tori of peace, progress and development we go dey hear,” Wike conclude.


