ABUJA – Federal Ministry of Environment don raise alarm say heavy rainfall fit cause serious flooding for 15 states and 69 different communities between September 24 and 28, 2025.
The warning come from the National Flood Early Warning Centre (FEW) of the Ministry, and na the Director of Erosion, Flood and Coastal Zone Management Department, Usman Abdullahi Bokani, sign am.
According to di Ministry, dis advisory na part of dem early-warning system wey dem dey always use protect life, property and farm produce during peak rainy season.
Flood wahala wey don dey ground
Flood no be new thing for Naija. Every year e dey scatter communities, displace thousands of people, destroy road and farmland, and even affect food supply.
National Emergency Management Agency (NEMA) data show say as of September 20, 2025, flood don:
Kill 232 people
Displace 121,224 Nigerians
Affect 339,658 people in total
Injure 681 people with different wound level
States & Communities wey dem list
The FEW Centre list plenty places wey fit dey under flood threat. Dem include:
Adamawa: Farkumo, Jimeta, Mayo-Belwa, Wuro Bokki, Yola
Anambra: Ogbakuba
Bayelsa: Amassoma, Ikpidama, Kalama, Kolokuma/Opokuma, Odi, Odoni, Ogbia, Oloibiri, Oporoma, Otouke, Peremabiri, Sagbama, Yenagoa
Borno: Damasak
Delta: Abigborodo, Aboh, Abraka, Agbor, Asaba, Forcados, Koko, Okoloba, Okpo-Krika, Patani, Sapele, Ughelli, Warri, Umugboma, Umukwata, Umuchi-Utchi
Edo: Benin City, Okada
Imo: Egbema, Oguta
Kano: Bebeji, Gezawa, Gwarzo, Kano, Karaye, Tudun-Wada, Wudil
Katsina: Jibia
Ondo: Akure, Ikare, Ita-Ogbolu
Oyo: Iseyin, Oyo
Rivers: Ahoada, Itu
Sokoto: Isa, Shagari
Taraba: Bandawa, Gembu, Ngaruwa, Serti
Zamfara: Anka, Bungudu, Bukuyum, Gummi, Gusau, Kaura Namoda, Maradun, Shinkafi
Government Advice
The Ministry don beg states, local government councils and emergency agencies make dem act fast to reduce flood impact.
“Heavy rain dey come between 24–28 September 2025 wey fit cause flooding for the listed areas. Stakeholders must prepare well and take preventive action,” di alert talk.
With rainy season don reach peak, experts say any delay fit increase human and economic loss.


