ABUJA – President Bola Ahmed Tinubu don give posthumous national honour of Commander of the Order of the Niger (CON) to the four late Ogoni leaders – Albert Badey, Edward Kobani, Theophilus Orage and Samuel Orage – wey pipo dey call Ogoni Four.
The ceremony happen Wednesday for Presidential Villa, Abuja, when Tinubu dey receive report from the Ogoni Consultations Committee.
Tinubu beg Ogoni people make dem drop division wey don last for decades, embrace peace and unity, and move forward as one voice.
“Make their memory continue to inspire unity, courage and purpose among us. I dey beg Ogoni people across all classes, communities and generations to close ranks, put this dark chapter behind una and march forward as one,” the President yarn.
The oga of the nation still yan say him government dey ready to support peace, environmental cleaning and economic development for Ogoniland. He confirm say plans dey ground to bring oil production back for the area.
According to am:
“I dey encouraged by the way Ogoni communities don agree say make oil production return. Government go use all resources to support una people so that prosperity go reach everybody.”
President Tinubu remind Nigerians say since 2022, the operatorship of Ogoni oil field don already dey NNPCL and their partners hand, and him government go build on top that decision.
Committee Report
Prof. Don Baridam, wey chair the Ogoni Dialogue Committee, talk say the consultation reach all four Ogoni zones plus people wey dey diaspora. The report carry key demands like:
Structured participation for oil production
Quick environmental cleanup
Sustainable development plan
He talk say the report dey show the collective mind of Ogoni people and e go act like blueprint for government action.
Ribadu React
NSA Mallam Nuhu Ribadu still reassure Nigerians say Tinubu government dey serious about Niger Delta peace and development.
“Peace don dey return small-small. Very soon Nigerians go see the benefit, not only for Ogoni, but for all Niger Delta region,” Ribadu talk.


