Senior Lawyer Talk Say Jonathan 2027 Case Na “Abuse of Court Process”

Oba Maduabuchi, wey be SAN, don blast people wey dey drag Goodluck Jonathan for court again, say dem just dey waste time.

Must read

Senior Advocate of Nigeria (SAN), Oba Maduabuchi, don yan say the case wey dem file for Federal High Court Abuja wey dey challenge former President Goodluck Jonathan chance to run for 2027 election na “abuse of court process.”

Maduabuchi talk this one on Tuesday as e remind people say one competent court for Yenagoa, Bayelsa State don already decide the mata before, and nobody don appeal that judgment since.

According to am, until dem cancel that old judgment, e still dey valid, so anybody wey dey try reopen the same mata for another court just dey waste time and dey abuse court process.

The SAN come explain say the constitutional amendment wey dem add for 2018 (Section 137(3))—wey talk say person wey don complete another person tenure fit only run one more term—no exist when Jonathan take oath for 2010 after President Umaru Musa Yar’Adua die.

E give example say before, judges dey retire at 65 years, later government change am to 70. But judge wey don retire before that law no fit come back say make dem reinstate am.

Maduabuchi still stress say law no dey work backward and say nobody fit use new law take cancel wetin no exist that time.

In im words: “When Jonathan take oath for 2010 and 2011, Section 137(3) no dey our Constitution. You no fit use 2018 law hold am for offence wey no exist that time. So anybody wey still dey drag am for court, na busy body e be.”

He end by talking say nothing for Nigerian law stop Goodluck Jonathan from contesting again, and say all the new case dem dey just to distract the man.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article