Nigerian Education Loan Fund (NELFUND) don open dia student loan application portal for 2025/2026 academic session. Dis one go help plenty students wey dey struggle pay school fees for university, polytechnic and college of education.
For statement wey dem release on Tuesday, the Director of Strategic Communications, Oseyemi Oluwatuyi, talk say the portal go dey open from October 23, 2025, reach January 31, 2026.
He advise new students make dem use dia Admission Number or JAMB Registration Number apply since dem never get matric number.
NELFUND also beg schools make dem no rush students wey never get dia loan money yet, but make dem give small time before dem close registration or collect school fees.
Dem still talk say any school wey never start dia 2025/2026 session suppose send dia academic calendar give NELFUND so dem fit plan well.
NELFUND yarn say e no go good make pikin wey wan learn drop out because of money wahala. Dem beg schools make dem allow students register temporary while dem dey wait for dia loan approval.


