Nasarawa State Governor, Abdullahi Sule, don talk say di plenty governors, senators and top politicians wey dey rush join APC from other parties na because of di strong reforms wey President Bola Tinubu don bring to move Nigeria forward.
Governor Sule yarn dis one for Lafia on Monday during welcome ceremony for Senator Ahmed Wadada, wey dump SDP to return back to APC.
He hail President Tinubu say e get liver to make tough decisions wey go benefit Nigerians.
“I wan hail President Bola Ahmed Tinubu,” Sule talk. “Na because of di kind reforms wey him dey do make governors and leaders dey come back to APC. Dem dey see di direction of this country and wan join hand for progress.”
Sule still reveal say for APC governors meeting for Kebbi, dem welcome Enugu State Governor, Peter Mbah, into APC and say more governors don dey join quietly.
“Dem no dey come back because of election alone,” he talk. “Dem dey come because dem believe in Tinubu policy.”
The governor come thank Senator Wadada for returning to APC and promise say him and him supporters go get equal chance for inside the party.
APC State Chairman, Aliyu Bello, also welcome Wadada and him team, promise say di party go give everybody equal chance for 2027 election. He still hail Governor Sule for him leadership and di plenty development for security, school and health matter.
Senator Wadada talk say him and him followers come back to APC because dem believe in the leadership of President Tinubu and Governor Sule.
As support for di party, Wadada donate 18 vehicles give APC leaders across senatorial zones and local governments for campaign movement ahead of 2027 elections.


