EFCC don detain former Attorney-General of the Federation, Abubakar Malami (SAN), over big-big allegations wey join terrorism financing, money laundering and suspicious movement of cash.

Tori from EFCC people talk say di former Minister dey answer questions about him alleged N10 billion investment for Kebbi State plus wetin happen to di $322 million Abacha loot wey come from Switzerland and another $22 million wey Nigeria recover from Island of Jersey for UK.
As at 10pm on Tuesday night, Malami still dey EFCC office because him never fit meet di bail conditions wey dem give am.
One source yarn say EFCC fit even seize some of di ex-Minister properties, while one of him wives go also face interrogation over alleged role for N4 billion Anchor Borrowers money wey dem trace.
But Malami don deny everything.
For statement wey he drop for X, he talk say he never ever dey invited or questioned by any agency for terrorism financing matter, whether for Nigeria or abroad.
He call di allegation “mischievous” and talk say him record as AGF show say he fight money laundering and terrorism financing, no be say he join am.
Malami remind Nigerians say under him tenure:
– Government establish independent NFIU to meet global standards.
– Dem pass di Money Laundering Act 2022 to tighten monitoring.
– Dem also strengthen di Terrorism Prevention Act 2022 to align with UN and global requirements.
EFCC investigation still dey continue as Nigerians dey wait how di matter go play out.


