Abuja — Former NFF oga, Amaju Pinnick, don clear air say e no thief or mismanage the $1.2 million wey FIFA give for the Goal Project stadium wey dem dey build for Kebbi State.
Wetin start the wahala be say FIFA post picture of the stadium for social media, and the building never complete. Nigerians begin vex ask wetin happen to the money.
But Pinnick, wey yarn for ARISE News on Wednesday, talk say everything for the project follow FIFA standard and dem audit every kobo.
“FIFA dey give you money, and dem dey check am from A to Z. That $1.1 million for 2020 na less than ₦400 million that time. No extra money, no change for the contract even after COVID wahala,” Pinnick talk.
E come beg Nigerians make dem check facts before dem dey talk anyhow. “Make we love Nigerian football and no dey talk wetin we no sure,” he add.
Meanwhile, House of Representatives don talk say dem go open special committee to check how FIFA and CAF grants wey reach $25 million enter NFF hand.


