Senate Don Approve Amupitan as New INEC Oga

Senate confirm Prof. Amupitan as INEC chairman after screening, e vow to restore credibility to Nigerian election

Must read

Senate don finally confirm Prof. Amupitan, di 58-year-old Law don, as di new INEC Chairman after dem screen am for more than two hours on Thursday.

Di Prof wey President Bola Tinubu nominate and National Council of State don endorse last week, go now take over from Prof. Mahmood Yakubu as di 6th substantive INEC boss.

For hin talk, Amupitan promise say e go make sure say Nigerian election go dey credible so till di loser go fit shake hand with di winner talk say, “You win fair and square.”

E talk say, “Na so justice suppose be — like when judge sentence person and di person talk say e believe say e don get justice.”

Di professor also talk say him go review Electoral Act to correct wahala wey dey for election timeline and to rebuild Nigerians’ trust for di voting system.

When dem ask am for Senate whether e be Tinubu lawyer for 2023 tribunal, Amupitan clear ground say, “I no be Tinubu, Obi or PDP lawyer for dat tribunal at all. I no appear for any of di cases.”

Senate President Godswill Akpabio come hail am, say Nigerians dey expect transparency and fairness under hin leadership.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article