Retired police officers wey don dey protest for National Assembly because dem jam dem put for Contributory Pension Scheme (CPS) fit soon get better news, as Senate don promise dem quick action to remove dem from di scheme.
For weeks, di retirees don dey sleep for Mopol gate for National Assembly inside makeshift tents just to make government hear dia cry.
Senate President Godswill Akpabio, wey meet di leaders of di retired officers for im office on Thursday, tell dem make dem relax, say Senate go fast-track di process to match wetin House of Representatives don already pass.
For statement wey him Special Assistant on Media, Jackson Udom release, Akpabio talk say:
“From wetin una tell us, di policy no make sense. Make una disperse from di gate. As far as law dey talk, di problem don finish. By Tuesday next week, Senate go concur with House and bring out Act wey go remove una from di Scheme. President Bola Tinubu, wey be listening President, go sign am sharp sharp. Di Scheme no good for security people at all.”
He add say if Military, DSS, NIA and other security bodies don comot for di Scheme, e no make sense say Police go dey inside.
“You and others dey fight insecurity together. Wetin good for one side good for di other side too. We go make sure say from Inspector-General reach last constable, na one Scheme una dey,’’ Akpabio talk.
CSP Mannir Lawal Zaria, wey lead di retirees, thank di Senate President for hearing dem and talk say dem dey hope say di matter go end well.
Senate Leader Opeyemi Bamidele also hail Akpabio for acting fast and showing concern for di officers wey don serve Nigeria.


