FIRS Executive Chairman, Dr Zacch Adedeji, don talk say for the new tax system wey go start January 2026, 95% Nigerians no go pay any tax at all.
Adedeji, wey Prof Abiola Sanni (SAN) represent am for Ilorin, yarn dis one after he collect award from Unilorin Alumni Association.
Accordin to am, the new tax arrangement no go stress people for bottom again. Instead, na the big people wey dey chop money for top of the economic ladder go begin pay their correct share.
He talk say the new tax system na the most business-friendly reform wey Nigeria don ever try, and e go make life easier for small businesses and workers.
Adedeji still reveal say from January 2026, FIRS go change name as part of new structure to modernise taxation for the country.
He add say even though some foreign countries dey collect up to 50% tax, for Nigeria, after all deductions, big earners no go pay pass 25% of wetin dem make.
He conclude say without solid tax system, Nigeria no fit build better roads, schools and other infrastructure.


