President Bola Tinubu don hail di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for di big work dem don do inside two years, wey include recovering over ₦500bn and securing more than 7,000 convictions.
Tinubu yarn dis one through Vice President Kashim Shettima for Abuja during di 7th EFCC–NJI Capacity Building Workshop for Justices and Judges. He talk say di achievement show say EFCC dey deliver result under him Renewed Hope Agenda.
According to EFCC spokesman Dele Oyewale, Tinubu talk say di money wey dem recover don enter back into di economy to fund Students Loan and Consumer Credit programmes.
“A Nigeria wey no get corruption dey possible if everybody do wetin right for their level,” Tinubu yarn. He come still salute di judiciary say dem be strong pillar for fight against corruption but warn say public trust fit collapse if judges and officials no lead by example.
Meanwhile, EFCC Chairman, Ola Olukoyede, raise alarm say plenty high-profile corruption cases dey drag for court because of legal delay and technical wahala. He accuse some lawyers and judges of using “procedure” take block justice.
Olukoyede talk say some judges for state high courts dey issue order to stop EFCC investigation, even when e no be their work. He call am “disturbing trend” wey fit weaken di anti-graft fight.
He beg judges make dem dey careful with their rulings, especially for cases wey fit affect public trust for EFCC and di justice system.
“Di longer corruption case stay for court, di more corruption go dey laugh us,” Olukoyede conclude.


