SERAP Warn CBN: Explain How N3tr Take Miss or We Go Carry You Go Court

Rights group demand explanation, recovery of funds and prosecution of officials

Must read

Rights group, Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP), don tell Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, Olayemi Cardoso, make him quickly explain wetin happen to the missing or diverted N3 trillion wey Auditor-General report expose for im 2022 audit book.

For the letter wey Deputy Director, Kolawole Oluwadare, sign, SERAP tell Cardoso make him reveal the people wey cause the money gbege and hand them over to ICPC and EFCC make dem investigate and prosecute them sharp-sharp.

SERAP come still ask say make CBN recover every kobo wey miss and return am to government account without delay.

The group yarn say the Auditor-General findings na “serious breach of public trust” and e show say CBN no dey follow transparency and accountability law as constitution and CBN Act talk.

According to the Auditor-General, CBN no remit over N1 trillion wey be Federal Government share of operating surplus enter the Consolidated Revenue Fund.

Another N629 billion wey dem pay under the Anchor Borrowers’ Programme follow enter hand of “unknown beneficiaries,” and CBN never recover the money.

SERAP remind CBN say Financial Regulations talk sey government no suppose pay for work wey dem never do or goods wey dem never supply.

The organisation warn say if CBN no act inside seven days, dem go carry matter go court.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article