Gunmen Carry More Than 200 Pikin From Catholic School for Nigeria

St Mary’s School for Papiri suffer heavy attack as bandits carry 215 students and 12 workers despite security warning

Must read

Wahala bust again for Niger State on Friday as gunmen wey people dey call “bandits” enter St Mary’s Catholic School for Papiri around 2:00am and carry 215 pupils plus 12 staff.

Di attack na di second big kidnap dis week, and e happen even after government order all boarding schools for Niger State make dem shut down because security wahala don increase.

Christian Association of Nigeria (CAN) confirm say fear don grip everybody for di area as parents dey cry and wait for news about their pikin. One woman tell BBC say her nieces, six and 13 years old, dey among di people wey dem carry: “I just want them to come home,” she cry.

One local resident, Dominic Adamu, say di whole community weak. “E shock everybody. People dey complain say security don finish for dis country,” he talk.

But Niger State government talk say di school no suppose even dey open. According to dem, St Mary’s reopen without clearance after warning say attack fit happen. Di school never respond to dat allegation.

Police and other security people don enter bush, dey comb di forest to rescue di children and staff.

Dis kidnap join di long list of wahala wey don face Nigeria dis week. For Kebbi State on Monday, bandits carry more than 20 Muslim schoolgirls from one boarding school. And for Kwara State, gunmen kill two people for church and carry 38 others during service wey dem dey broadcast live.

Di attack don force President Bola Tinubu to cancel him overseas trip, including di G20 Summit for South Africa, so he fit face di rising insecurity.

Meanwile, U.S. President Donald Trump and Defence Secretary Pete Hegseth don accuse Nigeria government of allowing Christian persecution—talk wey Nigeria reject, say terrorists dey attack both Muslims and Christians.

Nigeria still dey battle bandits, terrorist groups, and land clashes between herders and farmers. Kidnapping for ransom don turn normal even though government don ban ransom payment.

For Kebbi earlier dis week, two of di kidnapped schoolgirls manage escape, but 23 still miss.

More articles

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Latest article