Serious gbas-gbos shelle for U.S. Congress on Thursday as lawmakers begin drag each other over Nigeria security wahala, mass kidnapping and the wahala wey follow Donald Trump decision to put Nigeria back for Country of Particular Concern (CPC) list.
Trump wey talk say Nigerian Christians dey face genocide even threaten military action. Biden bin remove Nigeria from the list when im enter office, but Trump return am last month.
Inside the hearing, Congress split into two:
– One side dey shout say na “Christian genocide” dey happen for Nigeria.
– The other side warn say Nigeria wahala big pass religion matter and to simplify am fit scatter ground more.
Before the hearing, Congressman Riley Moore, one of the people wey dey push the genocide talk, hold meeting for Washington with Nigeria National Security Adviser, Nuhu Ribadu. Moore yarn say the meeting na “frank, honest and productive,” as dem discuss counterterrorism, security support and how to protect vulnerable communities.
Ribadu no go alone. E follow carry correct team:
– Minister of State for Foreign Affairs, Bianca Odimegwu-Ojukwu
– Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun
– Attorney-General of the Federation, Lateef Fagbemi (SAN)
– Chief of Defence Staff, Gen. Olufemi Oluyede
– Chief of Defence Intelligence, Lt.-Gen. Undiandeye, plus diplomats and advisers from ONSA and Nigerian Embassy.
For the hearing, Democrat Congresswoman Sara Jacobs blast Trump threat of military action. She call am “reckless,” warn say the talk fit put more people for danger.
She talk say Nigeria insecurity no be only Christian–Muslim matter. According to her, both sides dey suffer. Jacobs point the recent Eruku church attack for Kwara and the Kebbi State schoolgirl kidnapping as example of how the violence dey hit everybody.
This whole kasala dey happen as bandits and terrorists don increase attack for Nigeria, including the recent kidnapping of over 200 students from Catholic school for Niger State.


