Na serious gbege dey land for health sector as National Association of Resident Doctors (NARD) don declare say dem go enter five days nationwide warning strike.
The wahala go start Friday, September 12, 2025, and e go run till Tuesday, September 16, 2025.
For statement wey NARD General Secretary, Agbor Affiong, drop, dem talk say the decision na wetin dem agree after dem hold online National Executive Council (NEC) meeting wey run till early morning Thursday.
👉 “The strike go start 8:00 a.m Friday and end Tuesday, September 16. All centres make una inform una hospital management and continue to press for our demands,” na wetin the statement yarn.
Before now, NARD President Dr. Osundara Zenith don already warn say doctors go shutdown public hospitals if govt no act sharp-sharp.
Wetin dey pain doctors?
Poor working conditions
No power, no equipment for hospital
Small small salary
Govt dey downgrade their certificate
Shortage of manpower
Meanwhile, FCT branch of NARD don already dey for 7-days warning strike since Monday this week.
This new nationwide strike fit cause heavy wahala for hospitals across Naija, because resident doctors na the main backbone wey dey run plenty work for teaching hospitals and Federal Medical Centres.
Na Nigerians wey need hospital fit suffer pass if matter no settle quick.
✍🏽 TheStreetNewspaper

