Naija — Federal Government don finally scrap di 5% telecom tax wey Buhari government bin carry put for voice call and data subscription.
Na di National Orientation Agency (NOA) first break di tori on top dia X handle on Thursday.
Di Executive Vice Chairman of NCC, Dr. Aminu Maida, talk say na President Bola Tinubu order make dem remove di tax during discussion wey dem get ontop di new Finance Act.
According to am, di move go help reduce pressure wey don dey on Nigerians wey dey use mobile service, especially as tariff don jump by 50% earlier this year.
“Over 171 million active telecom users go feel di relief, as di President no gree make extra wahala fall on citizens,” Maida talk.
TheStreetNewspaper remember say Buhari government introduce di 5% excise duty tax for 2022 as part of plan to raise money when oil revenue dey drop. Dem bin talk say na normal thing for global taxation system.
But plenty telecom operators and consumer groups no gree. Dem yarn say di tax go only increase wahala for Nigerians wey already dey manage rising cost of living. Association of Licensed Telecom Operators of Nigeria (ALTON) even shout say di policy no make sense at all, since Naija telecom sector already dey carry heavy tax burden pass many African countries.
Now wey Tinubu scrap am, Naija people dey expect small relief for di money dem dey pay for data and call — even as government still dey find new way to raise revenue.


